Nneka - Kangpe Lyrics

Nneka - Kangpe Lyrics

Verse 1

So na so I be a condition come make you aje like this
You say your husband na him leave you,you say i go fit betray you.
So na so you dey weak
As I see you before I think say you dey kangpe
Nothing fit ,fit shake you, nothing fit , go fit break you
But you rake before
Na you talk say you no go put man before God
Oh,see yourself as you be
Na you talk say you no go put man before God oh

Chorus
As you know God no go give you anything you no go fit deal with
Na so dem talk,the thing wey no fit kill you
Na hin go make you strong it go make you strong
The thing wey no fit kill you na hin go make you strong,it go make you strong
God no go give you anything you no give fit deal with

Verse 2

You talk say,you be big man
because you fit raise your hand,fit beat your pickin beat your wife
You sabi,bible well oh
Dey go church everyday oh
Notice me or I quench
Look at me how I bounce
But na you be the crook
Na your kind fit open eye kill person misuse and abuse him
419,ole thief,basket mouth,ojoro
But you know how I be
When wind blow fowl yansh go open very very well oh

[Back to Chorus]

Yeah man
one question!
When was the last time you ever thank the lord almighty for your life?
When was the last time you tell your wife say you love am?
When was the last time you tell your son or daughter say you love them?

Bridge

As you walk through the valley of the shadow of death
You will fear no evil because his rod and his staff are with you
You have come this far to sing your mystery

0 comments:

Post a Comment

# Please correct lyrics @ comment box if the lyrics are wrong. Thx!